1. Chicken
wey run away from Borno go Ibadan go still end up inside pot of soup.
Meaning - YOU CANT RUN
AWAY FROM YOUR DESTINY.
2. Today's newspaper
na tomorrow suya wrap.
Meaning - KEEP CALM
NOTHING LAST FOREVER.
3. Cow wey
dey in a hurry to go America go come back as corn beef.
Meaning - JUST BE
PATIENT LET THE GAME COME TO
YOU, DON'T RUSH.
4. Akara and
moi moi get the same parent, na wetin dem pass through make dem different.
Meaning - HOW YOU
START DOESN'T MATTER, WHAT MATTERS IS HOW YOU FINISH.
5. If life
show you pepper, my guy make pepper soup from it.
Meaning - MAKE
SOMETHING GOOD OUT OF A BAD EXPERIENCE.
6. I get am
before no be property;
Meaning - STOP LIVING
IN THE PAST AND START LIVING IN THE PRESENT.
7. If person
too tey for party e go follow dem wash plate.
Meaning - DON'T
OUTSTAY YOUR WELCOME.
8. Craze no
hard to form na d trekking be wahala.
Meaning - EASIER SAID
THAN DONE.
9. No matter
how hot your temper be, e no fit boil beans.
Meaning - CALM DOWN,
YOUR TEMPER WON'T SOLVE THE PROBLEM.
10. Every
mallam with im own kettle, every northerner with im own radio.
Meaning - EVERY MAN
FOR HIMSELF.
11. Frog eye
no be open eye:
Meaning - HAVING BIG
EYES DOESN'T MAKE YOU CIVILIZED.
12. Bring
suya...bring suya, na cow body dey suffer am.
Meaning - EVERY ACTION
HAS A CONSEQUENCE.
13. E go
better e go better na im make ibo man still dey kano.
Meaning - WHEN THERE
IS LIFE THERE'S HOPE.
14. The
difference between ipekere and plantain chips na packaging.
Meaning - DON'T JUDGE
BASED ON APPEARANCE ALONE.
15. Escort
me, escort me, na so slave trade take start.
Meaning - SERIOUS
THINGS SOMETIMES START LIKE JOKE.
16. Pikin
wey use agbada take start, abeg wetin e go wear wen e old.
Meaning - SLOW AND
STEADY WINS THE RACE.
17. The
water wey dem use make eba can never be recovered back.
Meaning - DON'T CRY
OVER SPILLED MILK.
18. Better Soup na Money Kill am.
Meaning - WITH MORE MONEY, YOU GET MORE VALUE.
19. Person wey borrow clothe go party, no dey dance too much.
Meaning - DO NOT BE PROUD AND BRAG TOO MUCH.
20. Nearly no
dey kill bird.
Meaning - ITS EITHER YOU HAVE IT OR YOU DONT.
21. Fly wey no
get special adviser na im dey follow dead bodi enta grave
Meaning - DONT STAY IGNORANT.
22. No matter
how lizard dey do press up, e no go get chest like aligator
Meaning - BE PROUD OF WHO YOU ARE.
23. The cassava
today fit be gari tomorrow
Meaning - NO CONDITION IS PERMANENT.
24. Fowl wey dem
carry put for head no dey know say to waka na work.
Meaning - A DEPENDANT WOULD NOT KNOW THE VALUE OF WHAT HE/SHE IS ENJOYING.
Subscribe to our Email Updates to get the latest Articles in your Email instantly: Join our Email subscribers.









No comments:
Post a Comment
RULES FOR COMMENTERS: - 11/30/2018
1) Its good to say your mind about what you have read. Please do make ethical comment(s).
2) COMMENTS WITH UNACCEPTABLE LINKS (URLs) WILL BE DELETED IMMEDIATELY BY THE COMMENT MODERATOR.
If you won't abide by the rules please do not comment.
Thanks.